Ethereum wallets
To dey hold di keys tu yor digital fushure
Wallets dey helep yu asess yur digital assests and sign in tu aplikashons.

Wetin bi ethereum wallet?
Ethereum wallets na aplikashons wey dey give yu pawa ova yur akants. Di same way yur fisika wallet dey, im folow kontain evrytin wey yu nid to prove yur identity den folow handol yor assests. Yur wallet dey alow yu sign into aplikashons, read yur balans, send transakshons den konfam yur identity.
Wallets na wetin pipol dey yus handol dia digital assests and dia identity.
Yur wallet na tool wey yu supose yus interat wit yur Ethereum akants. E mean say yu fit dey swap wallet providas any taim. Plenti wallets dey wey fit alow yu manaj plenti Ethereum akants from one aplikashon.
Wallets providas nor fit kontrol yor funds. Dem just dey provide yu one window to si yor assets on Ethereum and tools to manaj dem izy.
One App wey yu fit manaj yor funds
Yor wallet go show yor balans, transashon history and e go give yu hau you fit take send/risiv funds. Some wallet dey do more things.
Yor ethereum akant
Yor wallet na yor window into yor ethereum akant - yor balans and many oda transakshon dey dia. But yu fit swap wallet providas anytaim yu wont.
Yor login wey dey for ethereum apps
Yor wallet dey alow yu konet to aplikashons as yu dey yus yor Ethereum akant. E just bi like login wey yu fit yus for plenti apps.
Wallets, akants, keys and address
E wort am make yu ondastand di difrens bitwin some words.
One Ethereum akants na two type of keys. Dem dey yus one key kreate di address wey yu fit shia for fri, and yu nid kip di oda key sikrit bikos na im yu go dey yus sign tins. Togeda, dis keys dey alow yu hold yor moni and make transakshons.
Ethereum akants dey always get address, di same way yor email folow get address. Dem dey yus dis sabi yor moni wey dey inside Crypto.
Wallet na tool wey fit make yu interat wit yor akants, as yu dey yus yur own keys. E dey alow yu si yor akant balans, send transashons, and do plenti oda tin s.
Most wallet go alow yu get Ethereum akant. So yu nor nid to do anytin bifor yu download wallet.
Types of wallets
E get some kain way wey yu fit sabi yor akant:
Fisika hardwia wallets na devices wey fit alow yu kip yor crypto offline -- e dey sikure wella
Mobile aplikashons wey fit make yu asess yor money from anywia
Browser wallets na web aplikashons wey fit let yu interact wit yor akant inside yor browser
Browser ekstenshon wallets na ekstenshons wey yu download wey alow yu interakt wit yor akant and aplikashon wit yor browser
Desktop aplikashon if yu wont manaj yor money thru macOS, windows abi Linux
Kompia difren wallets based on wetin dem get

Hau yu go stay safe
Make yu take sharge for yor own money
Exshange wey pesin dey kontrol go link yor wallet to one username and password wey yu fit rikova for normal way. Rimemba say yu dey trust dat ekshange wit pawa ova yur funds. If di ekshange get moni palava, yor moni go folow dey at risk.
Write yor seed fraiz down
Wallet go give yu seed fraiz wey yu supose write for somewia wey dey safe. Na di only way yu go fit rikova yor wallet.
Here na eksampol:
there aeroplane curve vent formation doge possible product distinct under spirit lamp
No store am for komputa. Write am down make yu kip am safe.
Make yu bookmark yor wallet
If yu dey yus web wallet, make yu bookmark di site to protet yorsef against skams mesaj.
Make yu shek evrytin wellla
Rimemba say dem nor fit rivarse transakshon and wallets nor fit rikova money izy so make yu wosh and dey kiafu always.